U-17 AFCON: Eaglets Ready for Battle

U-17 AFCON: Eaglets Ready for Battle

Nigeria Golden Eaglets don dey Tanzania to follow take part for the 13th Africa U17 Cup of Nations wey go shele from 14th – 28th April. The team go dey look to kolobi the U17 AFCON trophy again for Dar es Salaam on 28th April wen the tournament go end.

Dis one go be Naija 9th appearance for dis competition and dem don kolobi am two times , one for Seychelles for 2001 and for Togo for 2007.
Eaglets assistant coachee wey be Nduka Ugbade don even declare say the team ready gidigba to compete for the U17 AFCON and e say with the team wey dey so9, dem go fit kolobi ticket for World cup.
The Eaglets kpake the WAFU B U17 Tournament for inside  Niger Republic for September last year to take kolobi ticket enter Tanzania and dem go dey hope to kolobi one of the tickets go the FIFA U17 World Cup finals wey go now shele for Brazil later this year after Fifa comot am for Peru hand.
The Eaglets go gbege host Tanzanian on Sunday for the National Stadium, Dar es Salaam to take open their waka for the tournament.
B4 b4 U-17 coachee Emmanuel Amuneke wey be the head coachee of the Tanzania National Team, Taifa Stars dey also oversee the other National Teams of Tanzania and so go dey involve for their technical preparation. Na Amuneke bi dey in charge wen Naija kolobi fifth U-17 title for Chile.

 

Nigeria Group A with hosts Tanzania, Uganda and Angola. Group B get Cameroon, Guinea, Senegal, and Morocco.
Dis go be Morocco and Senegal second time for the tournament while  Cameroon and Guinea dey make their 7th appearance for the U17 AFCON. After Sunday kasala, the Eaglets go jam Angola on Wednesday, 17th April and come face Uganda for last group gbege on Saturday, 20th April.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!