U17 AFCON: Angola comot Naija for setting to kolobi 3rd place

U17 AFCON: Angola comot Naija for setting to kolobi 3rd place

Angola dey happy say at all at all na im bad pass as dem kpake the 3rd place finish for the Caf U-17 cup of Nations for inside Tanzania,for the National Stadium for Dar es Salaam.

The Palanquinhas happy say dem don revenge the 1-0 kondo akpako wey Nigeria carry samma dem for the group stage of the competition. Even as one of their players wey be  Porfirio Abrantis  collect Red card e no stop dem  from  ending the competition as the 3rd place team.

 

Striker Abdoul Barri tok before the gbege say dem ready do anything to kpake third place and dem do am wen dem kpokpo Golden Eaglets 2-1 to use kpake am. Even their coachee wey be Pedro Gonzalez tok say na the improvement wey im side improve after dem fall yakata to Nigeria helep ginger dem to beat the Eaglets for third place.

 

Nigeria na one of the strong countries wey dey the tournament but after the kpokporisation for Guinea hand join the plenty chances wey dem don miss, Manu Garba and im team go need to go back and find way to carry prepare wella for Brazil.

 

Tomorrow go be the turn of Cameroon and Guinea to trade tackles for the Final of Tanzania 2019.

 

Angola, Nigeria, Cameroon and Guinea don qualify to represent Africa for the FIFA U-17 world cup wey go come up for Brazil dis year.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!