U20 FIFA W/Cup: Time for preparation na now – Dosu Joseph

U20 FIFA W/Cup: Time for preparation na now – Dosu Joseph

Olympic ’96 Gold Medalist for football and b4 b4 naija international Goalkeeper Dosu Joseph don congratulate and carry advice give the U-20 boys as dem dey ready for Poland 2019.

 

E say preparation na the koko now and say if dem prepare well then dem go fit qualify from their group and even waka far for the tournament.

 

As e take concern striker positions and goals for the team, e say the problem na general one all over the world. E say caoches suppose waka round the country to find better young strikers wey dey hungry enough to deliver the goals.

 

The before naija Goalkeeper tok say to score goals dis days dey hard and say e no easy for strikers at all. As e take concern penarity matter, Dosu say na luck after all even the best players for world football sef dey lose too but sha o to master how to take penarity dey very important.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!