Union Berlin go play for Bundesliga next season

Union Berlin go play for Bundesliga next season

Union Berlin don kolobi promotion enter the Bundesliga for the first time for their history after dem play 0-0 draw after their relegation play-off second leg comot Stuttgart enter Bundesliga 2.

Na 2-2 e end for the two teams for the Mercedes-Benz Arena last week and the 2. Bundesliga side make sure say dem hole their visitors for the second leg to win promotion on top away goals.

 

Urs Fischer side bin missed out ontop automatic promotion on the final day of the season by goal difference and so dem know say na kpuff or be kpuffed against Stuttgart wey finish 16th in the top-flight on just 28 points.

 

Stuttgart go go back the second tier after two seasons wey dey spend for the Bundesliga.

 

With dis kolobi so Union don end their 10-year Waka for the second division with their first-ever Bundesliga status for the club history. Now dem go join Koln and Paderborn for the Bundesliga next season.

 

Meanwhile, Stuttgart, Hannover and last-place finishers wey be  Nurnberg don relegate.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!