USWNT dey eye Olympic qualification

USWNT dey eye Olympic qualification

E remain small tin make reigning FIFA Women World Cup Champions wey be the United States Women National Team (USWNT) to qualify for the 2020 Summer Olympic Games wey go shele for inside Tokyo.

The team go gbege Mexico on Friday, February 7 for the 2020 CONCACAF Women Olympic qualifying championship for the second semi final match wey go see the winner kolobi one of the confederation tickets enter the Women Football competition for the Olympics.

 

For another kasala Canada go jam Costa Rica for the first semi final tie tie on the same day.

 

USA 2020 CONCACAF Women Olympic qualifying championship waka dey make sense as dem carry better 6-0 kondo akpako Sama Costa Rica to carry kpake  Group A come still score 18 goals join and dem no concede any.

 

Now na Mexico dey stand between dem and the ticket enter Tokyo.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!