Valencia don go back im home Country

Valencia don go back im home Country

Antonio Valencia don waka comot Manchester United after 10-years and e don return back to im country Ecuador to sign for Liga Deportiva Universitaria.

The Ecuadorian outfit don come out to confirm say the 32-year-old don arrive and dem don sharperly post video of Valencia as e dey try know chacha surroundings.

 

The b4 b4 Manchester United player don touchlight im chacha club team dressing room, before e come try the club jersey and kits dem.

 

The right-back get plenty offers to stay for the Premier League but e make up im mind say im wan go back im native country.

 

Valencia bin start im career for Ecuador for Quito with El Nacional, before e come waka enter Spain for 2005 when e sign for Villarreal.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!