Vandals wan scatter Zlatan Statue

Vandals wan scatter Zlatan Statue

Tori say Vandals don try use saw to cut the feet of the statue of Zlatan Ibrahimovic and dem even put rope round im neck.

Police don put up one fence around the statue wey dey outside Malmo stadium for inside  Sweden in case e fall down.

 

Dis one go be the latest act of vandalism wey dem don direct at the statue since announcement come say Ibrahimovic don invest for one rival club last month.

 

B4 b4 Sweden striker Ibrahimovic bin make im professional debut for Malmo 20 years ago.

 

The b4 b4 Ajax, Juventus, Inter Milan, Barcelona, AC Milan, Paris St-Germain and Manchester United player dey look for im next club after e waka comot from LA Galaxy for the end of the MLS season.

 

On 27 November dem bin announce say Zlatan don kpake 25% of the shares for Hammarby, wey finish third for dis year Swedish championship.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!