VAR still need improvement but i like amSilva

VAR still need improvement but i like amSilva

Manchester City midfielder Bernardo Silva tok say im support the introduction of the video assistamnt referee VAR as im believe say e go helep referees improve the game with stronger decisions.

Silva na one of the ogbonge players wey Manchester City get wey helep dem kolobi ogbonge domestic treble for dis 2018/2019 season wey end so.

 

The 24-year-old no rest at all as  e follow  Portugal go kolobi the Nations League . Eve though say e support the VAR , e say the system still need plenty improvement.

 

Na Silva be the Blues Player of the Year for im ginger and contributions as Man city retain the Premier League title and e dey the form of im life dis season.

 

City go waka enter China next month for the Premier League Asia Cup before dem go come back come house to ready for the chacha season.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!