Wague say na hard work be the koko

Wague say na hard work be the koko

Moussa Wague don come out to yarn say im go continue to dey work hard as im dey try kolobi regular spot for Barcelona first-team wen next season go come.

Na against Girona Wague bin play im first La Liga game after im ginger wella for the reserve team for im breakthrough season with Barca.

 

The Senegal player bin train with the first-team wella on different occasions and dem even include am on the matchday squads even though say na only three appearances e make for the Spanish top-flight.

 

Wague follow inside Coach Aliou Cisse 23-man squad wey go play for the continental showpiece for Egypt and e dey hope say to use the competition to take show say im  deserve to dey Ernesto Valverde squad.

 

The Senegal international happy wella with the way im carry dey improve for  Barcelona even though say e no too get chance play.

 

Senegal dey for Group C for the Afcon and dem go begin their waka for Egypt against Tanzania on June 23 then dem go come play Algeria on June 27, and Kenya on July 1.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!