Walid Soliman don dey fit to play for Egypt

Walid Soliman don dey fit to play for Egypt

Egypt team director wey be Ihab Leheta tok say playmaker Walid Soliman dey fit to play for Egypt Africa Cup of Nations (Afcon)opening kasala against Zimbabwe.

The Al Ahly player Soliman bin woundjoor for the Pharaohs 3-1 kpake over Guinea last weekend and many bin tink say e no go show for Africas biggest Tournament.

 

But after e do scan, Leheta come confirmento say Soliman go dey available for Friday kasala.

 

The Pharaohs don already prepare finish and wella as dem ready to battle other countries to carry kolobi their eighth African crown and Javier Aguirre side go start dis waka of first Afcon title since 2010 against Zimbabwe on June 21,then come battle DR Congo and Uganda on June 26 and June 30.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!