We go work ontop awa defense and attack – Dennerby

We go work ontop awa defense and attack – Dennerby

Coachee Thomas Dennerby want make the Falcons improve wella ontop their defense and attck to take challenge the best teams for the World Cup.

Na the 59-year-old bin carry Sweden go finish third for the 2011 Women’s World Cup and e believe say the Super Falcons get chance and opportunity to do well for France but for dem to fit rise chest against the ogbonge teams for there , dem go need to work on the team Attack.

 

The Swede say the experience wey the girls gain from all the friend friend gbeges dey totori am e show say hope dey. The Falcons go appear for the eighth time for the Fifa Womens world cup for France and dem dey aim to waka pass the quarter-final stage dis time around.

Dennerby say the world cup different from friend friend gbeges and sy na different challge e be entirely and that is why dem need to work on how dem go take create and utilize their chances against the ogbonge teams dem.

 

The Super Falcons don play eight friend friend matches to take ready demsellves for the 2019 World Cup and dem win four come lose four, dem score 19 goals , conceed 12 and dis na one of the areas wey the coachy dey plan to work ontop.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!