Xavi don para for Abidal

Xavi don para for Abidal

Tori say no be only Lionel Messi dey para provoke for Eric Abidal comments dis week.Aproko wey dey come out from Spain tok say b4 b4 player wey be Xavi Hernandez sef dey vex with im b4 b4 team-mate.

Xavi don tell im friends say im no believe am say im b4 team-mate fit tok say im dey lie say the club bin wan offer am the chance to take over as Barcelona coachila after dem sack Ernesto Valverde.

 

Abidal bin come out to tok say na lie say Barcelona bin wan give Xavi the job as e tok say if im get any offer make e show the world make dem see.

 

Messi and Abidal don tarsis demselves publicly, after the sporting director bin tok say im blame some members of the Nou Camp dressing room for  Ernesto Valverde akpako  sack, na so Messi provoke tell am say make e emention names na.

 

Jordi Alba don already tanda gidigba for Messi back  while Gerard Pique tok say make everybody allow peace make e reign for the La Liga side as Barcelona continue their struggle to keep pace with their rivals Real Madrid wey dey hot like fire for the title race.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!