Transfer fee no dey pressure me at all – Pulisic

Transfer fee no dey pressure me at all – Pulisic

Christian Pulisic don come out to tok say im bin dey frustrated sake of say im no dey get chance play for Chelsea dis season but say im go try build ontop im ogbonge performance wey e perform afetr e come from the bench against Southampton.

Since im waka come from Borussia Dortmund go Chelsea for the close of last season, Pulisic don start three Premier League games and Frank Lampard no bother to put im name for the squad when Chelsea kpokpo Lille for the Champions League last week.

 

Mason Mount, Ross Barkley, Willian and Pedro don comot the 21-year-old American forward for setting.

 

The smallie from America still dey wait for im his first goal for Chelsea.

 

Pulisic bin sharp die as e come in as late substitute for the 4-1 league akpako nacking of Southampton on Sunday as e create one assist for Michy Batshuayi goal for the St Mary Stadium.

 

E tok say the £58-million transfer fee no dey pressure am at all but im know say people dey tarsis im performance wella.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
error: Content is protected !!