3 sports federations don get deadline

3 sports federations don get deadline

According to tori wey dey the Ministry of Youth and Sports don give three National Sports Federations deadlines to hole their Congress to take adopt and ratify their Constitutions dem. 

Aproko wey dey say na for meeting wey shele for inside Abuja with Federations’ Presidos, Secretaries and Technical Directors  na im Barrister Solomon Dalung yarn dis one.

 

 

The meeting touchlight matters wey affect governance of National Sports Federations dem and Naija preparations and participation for the 12th African Games wey go happen for inside  Morocco, join  the 2020  Olympic Games for inside Tokyo.

 

For the Handball Federation of Nigeria, dem get from now go reach October 31, 2019 to hold their own Congress to take  ratify their Constitution and submit am while the  Hockey Federation get till May 18, 2019 to submit their own join.

 

The Kickboxing Federation of Nigeria get reach July 31, 2019 to hole Congress and ratify their Constitution wey dem don already  review and submit.

 

Meanwhile dem don add Chess join the 23 sports wey Naija go participate inside for the  African Games while closed camping for the Games go start on July 5, 2019.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!