Algeria don fly plenty supporters enter Egypt for Nigeria Kasala

Algeria don fly plenty supporters enter Egypt for Nigeria Kasala

Algeria  go get plenty supporters and fans wey tanda gidigba for their back wen dem go gbege Nigeria for Sunday Africa Cup of Nations semi-final kasala.

The North Africans dey try reach their first final in 29 years but before dem go fit do that one dem gat to waka pass Genort Rohr men  for inside Cairo Stadium on Sunday.

Long ago , na Nigeria Algeria kpokpo to take kolobi their only Afcon title for 1990.

Tori wey dey say Algerian Ministry of Defence go use six military planes to take carry supporters and Ten Air Algeria planes go deliver 1 400 fans enter the Egyptian capital.

Dem dey expect the supporters to leave Cairo after the game, but dem fit stay for Friday final if Djamel Belmadi side win.

Amy side wey win go jam either Tunisia or Senegal for the 32nd African cup of Nations.

Na the ninth time wey dis two teams go face demselves for the competition history.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!