Barca and Neymar don enter one sokoto

Barca and Neymar don enter one sokoto

Barcelona and Neymar go jam for inside court for the end of September as the two parties dey sue each other for big kpogiris.

The Catalan club try wella dis summer to kolobi the Brazilian back enter the Nou Camp but dem no succeed as the transfer deadline bin pass on Monday.

 

Tori wey dey now tok say the 27-year-old go come head-to-head with im b4 b4 employers for one Barcelona court on 27 September, just three weeks on from the club attempt to carry sign am.

 

Neymar dey sue Barca for €26 million and the La Liga giants dey sue the player for €75 million.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!