Bayelsa Queens don answer the NWFL ontop non Registration mata

Bayelsa Queens don answer the NWFL ontop non Registration mata

The Management of Bayelsa Queens FC don come out to answer to the circular wey the Nigeria Women Football League bin release wey say na becos of say some teams including Bayelsa Queens no register make dem shift the date wey dem suppose kick off wey be Wednesday 17th July.

The Chairmo of Bayelsa Queens Ebiki Timitimi issue statement say the team na big team wey no fit tok say e no go comply with registration modalities for league wey dem kolobi last season.

 

The matter of non compliance dey in relation with the cost of cautions for the 2017/18 season wey Bayelsa FC management bin request say make dem breakdown the #230,000 wey dem say Bayelsa dey owe since March 2019.

 

Tori say the Management of Bayelsa Queens still pay kpogiri wey reach #200,000 on the 29th of April,2019 even though say dem no get proper breakdown from the Women League Board.

 

As e dey so on the 15th of July dem send breakdown of 30,000 to the club and immediately the club pay the money give the women league board, so therefore Queens believe say no be their fault.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!