Dem don cancel 2019 Rugby Africa Silver Cup

Dem don cancel 2019 Rugby Africa Silver Cup

Rugby Africa Presido wey be Khaled Babbou don inform Unions as per the decision wey Rugby Africa EXCO take to cancel dis year Silver Cup wey suppose shele for the Lagos Polo Club, Ikoyi for Lagos Nigeria.

Nigeria, Ghana, Madagascar and Botswana suppose play for the Silver Cup Pool A while Pool B gbege suppose dey between Cote d’Ivoire, Senegal, Mauritius and Rwanda.

 

The cancellation come after the premature comoting of hand of the sponsor leave Rugby without much kpogiri to take continue their plan for 2019.

 

Na one ogbonge sponsor be Rugby leading partner. Rugby Africa go advise on alternative format if e go dey feasible.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!