LAGOS GO HOST FIRST REGIONAL COACHING & MATCH OFFICIALS COURSES FOR AFRICA

LAGOS GO HOST FIRST REGIONAL COACHING & MATCH OFFICIALS COURSES FOR AFRICA

As part of the second Middle East Africa Championship wey dey go hold for  inside Lagos, Nigeria for early October, the first regional coaching and match official courses  go shele that same week. Na RLEF coach educators Martin Crick and Phil Smith together with Lebanon’s Nayef abi Said go lead the waka to make sure say everything dey on point. 

Ade Adebisi, wey be the vice chairmo and general manager of the Nigerian hosts too say dis one go be better chance to carry show Naija give the Rugby community dem.

 

This event go also form ogbonge part of the Nigeria Rugby League Association plan to grow the sport for 2019.Dem go deliver the cha-cha  level 1 courses wey together with the identification and mentoring of educator candidates for the region.

According to Jafaru Mustapha wey I’m country Ghana go make their international debut for the tournament, e say the courses go put dem ontop road wey go make Ghana become rugby league country with all the things wey dey go learn join the right coaching technique and application of the law.

 

Designated coaches and match officials dey part of wetin  Nations need to leave affiliate membership status of the RLEF and International Federation dem.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!