Nigeria 1-1 Uganda – Eaglets don qualify for AFCON semis, kpake world cup ticket join

Nigeria 1-1 Uganda – Eaglets don qualify for AFCON semis, kpake world cup ticket join

Nigeria U17 Golden Eaglets draw 1-1 against Uganda for their final group game to take cement their waka for the semi-final of the Caf U-17 Africa cup of Nations wey dey shele so for inside Tanzania and also kpake ticket fully enter World cup wey go shele for inside Brazil by September go reach October.

The golden Eaglets kpokpo host Tanzania 5-4 , Angola 1-0 kondo and Uganda 1-1 to take top group ontop 7 points. Angola come kpokpo host Tanzania 4-2 (6points)to take qualify ahead of Uganda wey finish group ontop 4 points.

 

Nigeria bin need draw/win to take tanda for the tournament and qualify for the world cup. Nigeria go play the 2nd runner Up for Group B and e fit be any of Guinea, Senegal or Morocco.

 

As e dey so the five-time world champions go begin dey ready to make sure sa dem finish well for the tournament. Na two times now Nigeria don kolobi the caf u-17 trophy and na for 2001 and 2007 so dis na another opportunity for dem to win am .

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!