Scotland get big hill to climb as Japan clean stadium after game

Scotland get big hill to climb as Japan clean stadium after game

Scotland dey face big task to qualify for the knockout stages of the World Cup as dem lose their second 2-1 game give Japan dis Friday.

The Japanese no give dem chance at all as dem dominate possession from the time the ref blow wistle for kick off till wen game end .Japan na the 2011 world cup winners and runners up for Canada 2015.

 

Na Mana Iwabuchi 23 mins goal and SUGASAWA 37′ mins PEN give Japan ginger before Clelland come pull one back for Scotland for the 88 mins but e no dey enough as dem fall yakata to their second straight defeat for the group stage for the World cup for France.

 

Scotland go now try to kolobi all the three points for their final group match against Argentina on Wednesday 19th June to stand any chance to qualify for the knockout stages.

 

As usual after the gbegerism , Japan fans make sure say dem clean the stadium where their team play and leave am clean as dem meet am.Dem don show say dem be better example to the rest of the world and some fans fit learn from dem.

 

No be the first time wey dem go clean stadium and even locker room after game be dis, dem do am after every game for Russia 208 Men’s world cup.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!