Tiger Woods dey ginger

Tiger Woods dey ginger

Tiger Woods tok say im waka come back to full fitness dey go tuele tuele and say e even fit return before time sef as e dey recover from the knee operation wey e do.

The world number 10 wey bin end im 11-year wait for his 15th major for April, bin do arthroscopic surgery for August to take repair cartilage damage.

 

The 43-year-old American now don waka enter Japan to play for the US PGA Tour inaugural ZOZO Championship.Before the ZOZO Championship wey go start on Thursday, Woods bin compete alongside Rory McIlroy, Jason Day and Hideki Matsuyama for The Challenge: Japan Skins.

 

Woods dey try round off im year as e go play for the Hero World Challenge from 4th go reach 7th December before e go come USA skippo for the Presidents Cup.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!