WBC DON REINSTATE WHYTE

WBC DON REINSTATE WHYTE

Tori say the WBC don formally reinstate British heavyweight boxer wey be Dillian Whyte as the mandatory challenger for Deontay Wilder World Boxing Council world heavyweight title.

Dis one come after dem drop Whyte doping violation charge. Na for June e bin provide one sample wey contained traces of one steriod wey dem don ban but UK Anti-Doping don withdraw the charge as dem say the levels dey very low.

 

Whyte now fit fight the person wey go win from the  Wilder versus Tyson Fury bout.That gbege dey ready to shele for February 2020 for inside America. and the WBC dey tok say Whyte go fight for one world title for the first time on or about February of 2021.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!