We gat to give everything – Ibom Angels Coach

We gat to give everything – Ibom Angels Coach

Head Coachee of Ibom Angels Football Club wey be Morufu Adeyemo Don carry warning give im  players say make dem no think am to use small eyes look their opponents for dis year State FA cup final, Police Machine Team.

Adeyemo tok dis one after the kasala between Police Machine Team and Dakkada Babes of Eket, wey finish 2-1 in favour of Police for the Uyo township stadium on Monday.

 

E say im  girls no go take am easy with  their opponent and say for did kine game of football anything fit happen.

 

Coaches Afternoon wey be say follow the game say im  and im players go so everything wey be say dey their power to make sure say dey kpake victory for that match.

 

E say dey go show their ginger and swagger come dis weekend for the Godwill Akpabio International Stadium wey be the venue of the final encounter,as kick time na for 2pm.

 

Already the two sides don  qualify to fly Akwa Ibom State flag for dis year FA Cup,as na two teams  den dey expect from each state to feature for the competition for  the national level.

 

Na Orange Girls, Ibom Angels be finalist for 2017 and 2018 editions of the FA Cup for women category dem.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
error: Content is protected !!