Arsenal go continue to dey buy Players – Kroenke

Arsenal go continue to dey buy Players – Kroenke

Director Josh Kroenke tok say Arsenal go continue to dey ginger for the transfer market after the summer where Unai Emery bin spend more than £100million ontop chacha players.

Fans bin don dey para for the way wey owner Stan Kroenke carry dey run the club and dem dey vex for the lack of investment in comparison to wetin their top six rivals dey spend.

 

But dem don break their transfer record as dem kolobi Nicolas Pepe from Lille for kpogiri wey reach £72m, and add others like  Kieran Tierney, David Luiz, Dani Ceballos and Gabriel Martinelli join and now e come be like say Arsenal don shift eye for their approach to back to Champions League football.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!