Derby County don enter one chance

Derby County don enter one chance

Tori say the EFL don charge Derby County sake of say dem make excess losses under FFP regulations.

The Championship club bin record the losses over three year period wey end June 30 2018.Dem go no send Derby go one independent disciplinary commission.

 

Derby wey dey 17th place for the Championship, go now face the possibility of points deduction.

 

The Club go now waka go one independent Disciplinary Commission, wey go will hear representations from both the EFL and Derby County dem.

Dem dey allow Championship clubs to lose £39million over three years.

 

Na last  year dem bin report say Derby dey suffer major monthly losses.

Last season Birmingham bin collect reduction of nine points sake of say dem breach the same financial rules dem.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!