Eto’o tell Salah to go join Best club for World

Eto’o tell Salah to go join Best club for World

B4 b4 Barcelona striker and Cameroon international wey be Samuel Eto’o Don encourage Egypt player Mohamed Salah Comot  Liverpool go join Barcelona.

Salah form dey hot like fire since im Waka come from  Roma for the summer of 2017. Na im score the opening goal im team Liverpool  Champions League final kpake over Tottenham June 1, one of 54 goals wey e Don score for  74 appearances.

 

Na Salah Liverpool bin comot Barcelona for setting for the UCL.

 

All dis ginger come make Europe top clubs dem come dey shok eyes put for am.  Naim make im name link with waka go bernabeu with Zinedine Zidane chacha galactico project for Real Madrid.

 

Eto’o sef like Salah bin also play for Chelsea and e  believe say the 27-year-old go fit in for the best club for World wey be would be Barcelona.

 

E also play for Real Madrid both for their academy and the senior side where e play three times.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!