FIFAWWC – Cameroon still dey para ontop VAR mata

FIFAWWC – Cameroon still dey para ontop VAR mata

As the women’s world Cup continue for inside France naija so VAR (video assistant referee) continue to dey cause quarrel. 

The latest team to fall Victim na Cameroon and their World Cup round of 16 clash with England nearly cause world war 3on Sunday after two VAR decisions go against the African side.

 

According to  begin VAR see,  Gabrielle Onguene bin dey offside position when dem bin  playe her inside, and the Cameroon bench no just gree the VAR decision .

 

Person fit even see say the Cameroon players no fit hole their cry after dem rule Ajara Nchout  early goal  for  the second-half offside for  the build-up.

 

Wetin pain the lionesses pass na the VAR decision wey lead to England second goal of the game earlier for the tie tie before half-time.

 

Ellen White bin dey offside position before she come collect pass from Lucy Bronze, come out the ball enter the bottom left-hand corner.

 

Officials sharperly disallow the goal, but VAR enter the matter come confirm say the goal na better goal.

 

April wey dey say some Cameroon players don use the vexation accuse FIFA say dey be racist’s.  England later kolobi the gorge 3-0 kondo and go jam Norway for the quarterfinals.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!