Martial don return to United training

Martial don return to United training

Tori say Manchester United forward Anthony Martial go start training this week, and hope don dey say e go dey fit to face rivals Liverpool on Sunday.

 

Martial don already miss eight games sake of the hamstring injury wey e get after e score two times for the opening three games of the season.So far say the 23-year-old France international no suffer any reaction,e go dey in contention to face Jurgen Klopp league leaders.

 

Liverpool go go Old Trafford as dem don kolobi their opening eight league games.United dey just two points ontop of the relegation zone, and na only two league games dem don manage kolobi dis season and dem never score pass more than once for any game since the 4-0 kondo kpake against Chelsea on 11 August.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!