Na second time for China for Lippi

Na second time for China for Lippi

Tori wey dey say China Don call back b4 b4 Italy coachee wey be nnayi ukwu  Marcello Lippi to come handle  the country National team again.

Dis one go make am the second time wey im go coach the team as den dey ready for the 2022 World Cup qualifying.

Marcello bin manage the Chinese team for more than two years before e comot  hand  sake of say den fall yakata for the  quarter-final for the Asia Cup.

Na im countryman wey be Fabio Cannavaro come replace am but now itself Don comot hand to go coach Chinese clubside  Guangzhou Evergrande Taobao.

Lippi don coach Juventus  before to go kolobi  five Serbia A titles for the two times wey e Don coach the club, e kpake the 1995-96 Champions League win e dey there too. E  come too carry Italy go pam 2006 World Cup to take become the first coachila to kpake both World Cup and Champions League title as manager.

Lippi go start work next month, wen China go jam the Philllipins and Tajikistan for friend friend  gbeges.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!