Pogba still dey hope to comot Man U

Pogba still dey hope to comot Man U

Paul Pogba still get hope of waka comot from Manchester United go Real Madrid after e like one social media comment wey dey tell am to move go Spain.

The Frenchman bin involve for long-running summer transfer kasala over waka to go play under Zinedine Zidane for Spain.

 

Although the transfer no materialise before the European transfer window close on September 2, e be like dem fit revive the deal again next year.

 

Pogba don start for all of Manchester United game so e even set up two goals for the opening-day akpako nacking of Chelsea.

 

Since e re-sign for then-record £89million from Juventus for 2016, Pogba don kolobi 31 goals for 139 appearances for United.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0