Real Madrid kpake Japan smallie player

Real Madrid kpake Japan smallie player

Tori say Real Madrid don kolobi Japanese teenager Takefusa Kubo as dem describe am as one of the most promising ogbonge young players for world.

The Japanese midfielder go join Real Madrid Castilla wey be the club reserve team.

Kubo wey be 18 years dey international duty with Japan for the Copa America  and e make im international debut on June 9 against El Salvador.E don play 13 times for FC Tokyo for 2019, kolobing four goals.

Aproko from Spain say Madrid go pay Japanese top-flight side FC Tokyo 2m euros (£1.78m) for the smallie player.Kubo bin dey Barcelona book from the ages of nine go reach 13 but return home when dem find the Spanish club guility of youth transfer breaches, come collect akpako transfer ban.

Accoding to yarn wey dey, Madrid bin offer the small boy five-year contract wey dey worth 1m euros (£890,000) a year.

Dem say Kubo na attacking midfielder wey get excellent technique and great vision for the game”.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0