Rohr lists players for AFCON 2019 camp waka

Rohr lists players for AFCON 2019 camp waka

Nnayi Ukwu Coach Gernot Rohr Don bring out list of 25-man squad to carry ready for the 32nd Africa Cup of Nations finals for inside Egypt dis summer. Six other players dey for  standby.

Mikel Obi wey never play  for Naija since the world cup finish  bin seal im Waka come back the National team after im  sidon yarn with Coach Rohr for the United Kingdom and dis one mean say e fit add join  im  85 international caps.

Rohr make sure say e keep the guys wey helep am kolobi the ticket enter the  AFCON finals with one match wey remain as e retain goalkeeper Francis Uzoho, defenders Leon Balogun and William Ekong, midfielders Oghenekaro Etebo and Wilfred Ndidi and forwards Odion Ighalo, Alex Iwobi and Moses Simon also on the roll-call.

Defenders Ikouwem Utin and Valentine Ozornwafor wey dem name for Naija final 21 for the FIFA U20 World Cup wey go start for Poland next week dey inside the six players wey dey standby. Tori say Rorh put the two players for stand by sake of say the FIFA U20 World Cup go end 15th June, six days before the first match go shele for the AFCON.

All the  players and officials must to report for inside Asaba on Sunday, 2nd June ahead of the friend friend gbege with the Warriors of Zimbabwe for the Stephen Keshi Stadium on Saturday, 8th June.

The team go travel go Egypt on Sunday, 9th June and tackle Senegal for their final pre-AFCON friendly on Sunday, 16th June.

Nigeria go jam Burundi, Guinea and Madagascar for the  Group B of the Africa Cup of Nations wey go shele for Egypt  from 21st June go reach 19th July.

Na the full list of the  25 EAGLES FOR AFCON 2019 CAMP be dis:

Goalkeepers: Francis Uzoho (Anorthosis Famagusta, Cyprus); Ikechukwu Ezenwa (Katsina United); Daniel Akpeyi (Kaizer Chiefs, South Africa)

Defenders: Olaoluwa Aina (Torino FC, Italy); Abdullahi Shehu (Bursaspor FC, Turkey); Chidozie Awaziem (Caykur Rizespor, Turkey); William Ekong (Udinese FC, Italy); Leon Balogun (Brighton & Hove Albion, England); Kenneth Omeruo (CD Leganes, Spain); Jamilu Collins (SC Padeborn 07, Germany); Semi Ajayi (Rotherham United, England)

Midfielders: Mikel John Obi (Middlesbrough FC, England); Wilfred Ndidi (Leicester City, England); Oghenekaro Etebo (Stoke City FC, England); John Ogu (Hapoel Be’er Sheva, Israel)

Forwards: Ahmed Musa (Al Nassar FC, Saudi Arabia); Victor Osimhen (Royal Charleroi SC, Belgium); Moses Simon (Levante FC, Spain); Henry Onyekuru (Galatasaray SK, Turkey); Odion Ighalo (Shanghai Shenhua, China); Alexander Iwobi (Arsenal FC, England); Samuel Kalu (Girondins Bordeaux, France); Paul Onuachu (FC Midtjyland, Denmark); Kelechi Iheanacho (Leicester City, England); Samuel Chukwueze (Villarreal FC, Spain)

The Six wey dey on Standby na: Theophilus Afelokhai (Enyimba FC); Bryan Idowu (Lokomotiv Moscow, Russia); Ikouwem Utin (Enyimba FC); Mikel Agu (Vitoria Setubal, Portugal); Junior Ajayi (Al Ahly, Egypt); Valentine Ozornwafor (Enyimba FC)

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!