See U-20 Gbegerism as world cup don finally start for inside Poland

See U-20 Gbegerism as world cup don finally start for inside Poland

For the first games wey dem Don play so, Colombia pour sand for the Garri of host Poland.  The South Americans kpokpo dem 2-0 kindo for group  A.  Japan and Ecuador share draw soup 1-1, Mexico fall 2-1 give Italy.

Senegal wey be one of Africa team for the World Cup carry better beating give Tahiti,  e end 3-0 kind. Senegal player wey be Amadou Sagna set record as the person wey score the fastest goal for the competition history,  e score am seconds (9.6 secs) after Ref blow whistle for kick off and make am hat trick against Tahiti.

 

Na naija Monday Odiaka bin get the record before for 1985.

 

Meanwhile, Paul Aigbogun and im team go dey hope to start their Waka for the tournament on top better note as dem ready to kolobi all 3points against Qatar later today for their first match of the FIFA U-20 world cup.

 

Coachee Paul Aigbogun Don too am say dey no go use small eyes look any team at the on-going Fifa U20 World Cup.

 

Nigeria never kpake the U20 World Cup but den Don finish as runners up for the 1989 and 2005 editions for the back of Portugal and Argentina.

 

Naija wey be the  2005 runners up go still gorge Group D rivals Ukraine and USA for a chance to reach the knock-out stages of the competition.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
error: Content is protected !!