Super Falcons preparations dey on point – Chukwuonye

Super Falcons preparations dey on point – Chukwuonye

Super Falcons player wey be Josephine Chukwunoye believe say all the preparations wey the team don do to carry ready for France 2019 go really go helep the team.

E say make people no judge the team base on their waka for both China and for the Cyprus women tournament as e say room dey to improve wella, world cup still dey like 2 Months plus away.

 

According to Jojo, the team and coaching crew dey work hard to make sure say everything dey on point before the World Cup proper for France.

 

E say things don change for good pass before wen the team no dey see all dis kine tournament to take prepare. And for the way wey coach Thomas Dennerby carry dey handle things, e say that one sef dey different as oyibo wey e be.

 

Chukwunoye come carry advice give people wey dey handle Naija womens league say make dem make we league better.

 

She say make coaches try make training dey more flexible so that some of dis girls go fit get work, go school, learn work and do other things wey go helep ready dem for future in case football no dey again as woman time no be like man own.

 

She tok say for obodo Oyibo where she dey play for Asarums If for the Swedish division 1, girls wey be professionals for other work dey play and still dey work and she believe say if we go fit do the same here, e go make we league dey stronger and good.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!