UFC fighter Romero kolobi $27.45 million

UFC fighter Romero kolobi $27.45 million

Tori wey dey on ground say Cuban mixed martial artist,  former freestyle wrestler and  UFC fighter wey be Yoel Romero don kolobi $27.45 million for a lawsuit against one supplement company.

Na for December 2017 Romero bin file the lawsuit and the company wey e file an against no free tok so Romero kpake a default judgment. I’m manager wey be Abe Kawa yarn say the judgment na for $27.45 million.

 

The whole gbege start for 2016 wen Romero bin fail one out-of-competition USADA drug test for one substance wey dem call Ibutamoren wey dey stimulate growth hormone.

 

Romero come deny say im purposely take the banned substance,as e tok e come from one tainted supplement.

 

USADA come provoke test the supplement wey Romero bin take and come find out say true true say e dey present even though say the supplement company no put am for their label. Becos of dis result USADA come ban nwoko oma yoel for Six .

 

But the fighter dey vex sake of say dis matter don stain im career and im spotless record (as Olympic wrestler wey im be dem don drug test Yoel more than any other competitor wey currently dey for UFC).

 

Na for Middlesex (N.J.) County civil court im file the lawsuit against Gold Star Performance Products.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!