World Cup no be Nations Cup o – Oparaku warns Eaglets

World Cup no be Nations Cup o – Oparaku warns Eaglets

With the falling hand of golden Eaglets for the CAF U-17 African cup of nations wey just finish for inside Tanzania wey den finish 4th, b4 b4 Ex international wey be Mobi Okparaku don come out to para unto the way the team carry perform.

Mobi say naija never carry 4th before, e say im feel say people no happy at all with wetin happen but say make the coaches go back go know wetin dey wrong so that dem go fit correct am before the world cup proper for Brazil.

 

E say the boys dey sharp but dem no get finishes and finishers, the defence line no get Nigerian flavor.

 

According to am,  Nigerian flavour na make we just pass the ball make e enter and no be to play style. E say dem need to change their style as World cup and afcon no resemble at all.

 

The b4 defender say the difference then and now as e take concern developmental football na say dem take am seriously and the NFF dey prepare players wella but say dis days coaches go send agents and scouts to go pick players wey no get business for the team.

 

Now anybody dey enter team, coaches no dey go competition go pick players again. Man know man and money change hands dey put players wey no deserve am inside team nowadays.

 

The b4 b4 Anderlecht player say age na another problem entirely, e say  if Naija fit dey encourage sports festival s and school sports, e say the coach go see players wey dey the age wey e want and e go fit use im hand pick dem and nobody go bring player come for am like that or bring money give am to play player .

 

E say if the country fit encourage all dis school sports the issue of age  cheat go stop.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!