Anti-racism campaign: Serie A don dey beg

Anti-racism campaign: Serie A don dey beg

Serie A don comes out to apologize after one artist use the picture of monkey for one artwork wey dem wan use for one anti-racism campaign.

The league don receive plenty heavy tarsis from Italian clubs AC Milan and Roma as well as anti-discrimination organizations for the posters.

 

The league chief executive wey be Luigi De Siervo tok say im know say e no good at all an e don beg everybody.

 

But the Artist wey do is one wey be Simone Fugazzotto don stand by im creation as e tok so all of dem na monkey. The issue bin come less than three weeks after the clubs pledge say dem go join hand combat Italian football “serious problem”.

 

Anti-discriminatory join body Fare tok say dem still dey speechless and the campaign be like one “sick joke”, while Kick It Out add join say the use of monkey no make sense at all as e  no dey appropriate.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!