Cameroon don send delegates to go beg Matip to come back for AFCON

Cameroon don send delegates to go beg Matip to come back for AFCON

Aproko wey dey say the Cameroon Football Federation (Fecafoot) wan send delegates go jam with Liverpool and indomitable Lions player Joel Matip and follow am yarn unto coming back to the team to helep dem go defend their title for the Nation’s Cup for Egypt.

The UEFA Champions League winning defender bin get beef with the b4 b4 coaching staff of the side and becos of am e no play for the 2017 Afcon wey Hugo Broos carry  Cameroon go kolobi for Gabon.

 

Coachee of Cameroon wey be Clarence Seedorf don tok am early dis year say nobody go beg Matip and Nicolas Nkoulou to come back but say if dem use their church mind come back im go allow dem enter team.

 

Matip don represents Cameroon for the Fifa World Cup for 2010 and 2014 but e never play for dem for the African continent before.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0