Esperance, Wydad Casablanca don lodge appeal for CAS

Esperance, Wydad Casablanca don lodge appeal for CAS

Tori say Tunisia Esperance and Morocco Wydad Casablanca don go lodge appeals for the Court of Arbitration for Sport (Cas) sake of the decision wey CAF take for dem to replay the second leg of the African Champions League final.

The Confederation of African Football (Caf) command say make dem replay the match sake of say the conditions of game and safety no reach.

 

Caf decide dis one after Wydad decide to waka comot from the pitch after Referee disallow the equalizer wey dem score.

 

Esperance bin dey lead 1-0 kondo for the second leg for the time and 2-1 overall.

 

Wydad bin want make the Referee go check the Video assistant referee to see if the goal go stand or not but dem come find out say the system no dey work, na so dem declare Esperance champions.

 

Later that week, Caf come tell Esperance to bring the Champions League trophy and their winners medals.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!