Manchester City fail for their appeal

Manchester City fail for their appeal

Manchester City try but dem don fail their initial bid to get the Court of Arbitration for Sport (Cas)to stop Uefa shook eye enter inside possible breach of Financial Fair Play (FFP) rules dem.

Dem don refer City go Uefa financial watchdog, wey be the Club Financial Control join Body (CFCB) and if dem find dem guilty, dem fit could face one Champions League ban.

 

Cas tok say dem no fit admit City appeal for dis stage sake of say the CFCB never still determined wetin if any, punishment dem go apply if dey find dem guilty.

 

The club, wey don deny say dem no do anything wey bad don argue say Uefa no get any authority to bring any FFP case against dem.

 

Tori wey dey say City purposely mislead Uefa so that dem go fit meet FFP rules wey require clubs to break even.

 

Dem don fine the Premier League champions, FA Cup and League Cup winners kpogiri wey reach £49m for 2014 sake of say dem breach regulations.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!