Salah dey go Olympics

Salah dey go Olympics

Egypt don confirmento their plans to name Liverpool star wey be Mohamed Salah for their squad wey go play for dis summer Olympic Games wey go shele for inside Tokyo Japan.

Egypt Under 23 coachila  wey be Shawky Gharib don tok say notin dey pa say Salah go be one of the three senior stars wey dem go name for their squad for the ogbonge event.

 

Dis kine news of Salah inclusion go shake Jurgen Klopp o as the German  bin want make one of im star players dey with am  during pre-season.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0