Italian footballers don kolect akpako ban

Italian footballers don kolect akpako ban

Tori say two Italian footballers don collect one-match akpako bans sake of say dem blasphem wen dem dey play for inside Serie A matches.

Tv been show Sassuolo player wey be Francesco Magnanelli and Parma player wey be Matteo Scozzarella where dem dey make blasphemous tok for separate cases.

 

Tori say strict ban dey for Italy as e take concern to dey yarn God name anyhow and even the nation football association don para discipline players wey dem hear say dey do so since 2010.

 

Udinese midfielder Rolando Mandragora bin collect akpako ban for the same offence for 2018.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!