Real Madrid give Chelsea till June 30 to take kolobi Mateo Kovacic

Real Madrid give Chelsea till June 30 to take kolobi Mateo Kovacic

Tori say Chelsea get reach the June 30 to take kolobi  Real Madrid midfielder wey be Mateo Kovacic.  

The Blues no go fit kpake am ontop permanent deal if im loan waka expire and their transfer ban don dey in place.

 

Kovacic bin spend last season for  Stamford Bridge and the Croatian future fit be one of the first items wey go dey nnayi ukwu Frank Lampard wey dem go soon announce as new manager agenda on Wednesday.

 

Kovacic na registered Chelsea player as part of the loan waka and the ban go allow them to permanent any player wey don already dey ontop their books.

 

The midfielder bin ginger wella as regular for the side last season under Maurizio Sarri and e make 51 appearances for all competitions.

 

Aproko wey dey say Real go dey expect £44million for Kovacic and Inter Milan sef don turn monitoring spirit as dem dey also monitor the situation.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!