Fury wan fight Joshua for Amerika

Fury wan fight Joshua for Amerika

Boxer Tyson Fury want make im fight with Anthony Joshua shele for inside  Las Vegas.

The b4 b4 heavyweight world champion must first of all comot  Deontay Wilder for setting when the two of dem go jam for their rematch on February 22.

 

Joshua sef go gat to kpokpo mandatory challengers Kubrat Pulev and Oleksandr Usyk too. If two of dem fit win thier fight na im be say Fury go target one fight with im domestic rival wey bin re-kolobi im three belts from Andy Ruiz Jr last year for inside Saudi Arabia.

 

Eddie Hearn  wey be Joshua  promoter  don tok say the Brits fit kpake £115million each if the fight go hold for  Saudi Arabia, compared to the £30m wey dem go get if e hold for inside Wembley for England.

 

As e dey so  Fury wey don fight im two last  fights for Las Vegas, want to continue im stay for the Sin City.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!